Simi Talk Say She Never Chop Heartbreak Before
Written by YangaEditor1 on May 7, 2025
Simi Talk Say She Never Chop Heartbreak Before
Popular Naija singer and songwriter Simi don yarn say she never ever chop heartbreak before. She talk say na because she sabi waka commot from anything wey no favour am or dey make am feel anyhow. The award-winning artiste gree say she don feel emotional pain before, but true heartbreak never reach her side.
“I no think say I don ever chop heartbreak, but I don feel hurt before. I no get any memory say heartbreak don hit me, but e fit be say na me don break person heart,” Simi talk.
She come explain say she dey always put her own emotional well-being first. Once she sense say something no pure or no dey make her happy, she go just cut off from am.
“I be that kind person wey go talk say I no want make person dey with me because dem dey pity me or dem no wan make I feel bad. If e go pain me, make e pain me, I go heal. Na so I dey run my matter. If I see say e no dey work, I go just waka,” she add.
Simi talk say the reason wey she never experience real heartbreak na because once she sense say something no good for her, her brain go just give her signal make she bounce.
“I never chop heartbreak before because once I feel say something no good for me, my head go just reason say make I walk away. Na so I be.”
She still talk say this way of life no be only for romantic relationships, e still cover friendship and any other kind of relationship.
“No be only for love matter. If I get friend wey dey make me feel somehow or unsafe, I go sharply cut am off. I no get strength for wahala. I get anxiety, so I dey protect my peace, Na why I dey talk say I no remember ever getting heartbreak. But I don feel pain before. If you love person, dem fit still hurt you small.”