Yanga FM 89.9

Compound Wahala

Compound Wahala

Compound Wahala by Presented by Rugged Pastor & BabyLawyer


Info and episodes

Falz Don Stir Wahala Say: To Knack Before Marriage No Be Sin

Written by on May 12, 2025

Falz Don Stir Wahala Say: To Knack Before Marriage No Be Sin

Popular Naija rapper and human rights advocate Falz the Bahd Guy don cause serious online drama after e talk say fornication (to knack before marriage) no be sin, even though Bible talk otherwise.

Falz Don Stir Wahala Say: To Knack Before Marriage No Be Sin

Falz Don Stir Wahala Say: To Knack Before Marriage No Be Sin

Falz drop the gbosa tweet for X wey dem dey call Twitter before on May 11, 2025, where e write:

“Fornication is not a sin.”

Na that tweet scatter everywhere. Some people support am say na freedom of speech, but many others – especially church people and Bible scholars drag am wella, use Bible verses correct am.

See Wetin People Dey Yarn Online:

  • “Fornication na sin, FLEE!”

  • “Na lawyer talk this thing? I shock. May God help you.”

  • “Now I understand why you never marry 🤣🤣.”

  • “At your big age, you still dey find clout?”

  • “No let anybody deceive you. To knack before marriage dey affect your body, soul, and spirit. Stay safe abeg!”

  • “E fit no be sin to you, but na disobedience to God be that.”

  • “Read your Bible well — 1 Corinthians 6:18.”

  • “No be everything wey no be sin good — religion don twist many things.”

Falz no be stranger to controversy. As lawyer and activist, he dey always talk wetin dey shake table. But this one don touch deep matter – religion, morals, and wetin youths for Nigeria dey believe today.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist