Yanga FM 89.9

ID Cabasa Don Blast Akon Say No Be Im Create Afrobeats

Written by on May 12, 2025

ID Cabasa Don Blast Akon Say No Be Im Create Afrobeats

Baba wey sabi music wella for Naija, ID Cabasa, don open mouth talk say wetin Akon yarn for one American interview no follow at all. Akon bin talk say na him help build Afrobeats and make the whole world know am.

ID Cabasa Don Blast Akon Say No Be Im Create Afrobeats

ID Cabasa Don Blast Akon Say No Be Im Create Afrobeats

The Senegalese-American singer talk say na him sign Wizkid first and him collabo with Naija artistes na wetin ginger the movement wey we dey call Afrobeats today.

But ID Cabasa no gree that one. E say Akon no get right to dey carry chest say na him build Afrobeats. He say people like 2Face, 9ice, andTimaya don already dey shut down the scene before Akon even reason say e go enter Naija.

“Akon fit even talk say na him discover 2Face and 9ice join. The people wey he meet when he reach Naija just gas am up, tell am say dem be biggest thing. That one no mean say na him create Afrobeats,” Cabasa tok.

He still clear the air say na Banky Wfirst discover Wizkid and sign am for EME before dem even talk partnership with Akon label.

“Yes, Akon help distribute some of our jams abroad, but make e no dey talk say na him start Afrobeats. That na big lie. Afrobeats na culture, na plenty people hustle build am.”

Cabasa end am with talk say make Akon no dey make mouth on top another person hard work. Na Naija musicians really build the foundation wey the world dey dance to today.

 


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist