Yanga FM 89.9

Presented by Suo, MC Advice

Yanga Sports

Yanga Sports

Yanga Sports by Presented by Suo, MC Advice


Info and episodes

Lil Kesh Talk Say Marriage No Dey Work, Say E No Believe for Am

Written by on May 12, 2025

Lil Kesh Talk Say Marriage No Dey Work, Say E No Believe for Am

Nigerian singer and rapper, Lil Kesh, don open up say he no believe for marriage, talk say the thing no dey work like that.

Lil Kesh Talk Say Marriage No Dey Work, Say E No Believe for Am

Lil Kesh Talk Say Marriage No Dey Work, Say E No Believe for Am

For one recent episode of The Esther Show, the “Shoki” crooner yarn as e be say e don dey single for long and no get plan to marry any time soon.

“I dey single now. I don dey single tey. I break up with my last babe because I realize say I fit do better alone – career and every other priority wey I get that time,” Lil Kesh talk.

Him yarn say even though e go sweet to meet one person wey go make am wan settle, him no dey find love with seriousness for now.

“If I dey date person, I go need make time for the person. But I never dey that headspace now. I don be 31 years old. My papa and mama no dey even pressure me to marry. Dem don accept say I different.”

As dem ask am about marriage, the singer sharply reply:
“Marriage? Maybe later, but for now, my mind no dey there.”

E come add say he no wan use play play give woman belle or go rush marry person just because say people dey expect am.

“No be say I wan dey single make I dey waka waka or dey chase girls up and down. I just no believe say marriage dey work. You don see how divorce full everywhere? I don see many unhappy marriages. No be say happiness no dey for marriage oh, but me I wan happy home—and I no sure say I fit do am now.”

E come end the gist say, “I no go use another person happiness do sacrifice just because say dem talk say I must marry.”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist