Yanga FM 89.9

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija


Info and episodes

Portable and OdumoduBlvck Don Cook Beta Jam – Gbedu Wey Go Scatter Street

Written by on May 14, 2025

OdumoduBlvck And Portable Don Cook Beta Jam – Gbedu Wey Go Scatter Street

As street pop star Portable take announce before, him collabo with award-winning rapper OdumoduBlvck don ready gidigba.

Portable and OdumoduBlvck Don Cook Beta Jam – Gbedu Wey Go Scatter Street

Portable and OdumoduBlvck Don Cook Beta Jam – Gbedu Wey Go Scatter Street

Odumodu preview the gbedu wey never drop during him sold-out show for Ibadan, one of di stops for him tour wey dem tag The Greatest University Tour.”

Di jam get that uptempo beat wey Portable dey always kill – e blend Yoruba fuji vibes with Afrobeats, and as usual, Portable deliver wella.

Dis collabo show say OdumoduBlvck no just sabi rap, him sabi relate with street and e dey open to work with artistes wey dey rep grassroots gbedu.

For Portable, na another big win for him career — remember say him don collabo with Olamide and even Skepta before.

Na for April Portable first yarn say dem dey work together, and for di same IG video, he reveal say Odumodu dash am ₦5 million.

“E good to dey work with beta people… God bless you Odumodu,” Portable talk for di video as he yan say dem go even share royalties for di song together.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist