Yanga FM 89.9

I Bin Get cancer Scare And Dem Comot My Thyroid – Mercy Johnson 

Written by on May 19, 2025

I Bin Get cancer Scare And Dem Comot My Thyroid – Mercy Johnson 

“I bin think say I get cancer, dem come remove my thyroid” – Mercy Johnson tok about why she don lose weight

Mercy Johnson Don Yarn Why She Dey Loose Weight

Mercy Johnson Don Yarn Why She Dey Loose Weight

Nollywood actress Mercy Johnson-Okojie don open up about di health wahala wey she face and why she don lose weight sharp sharp.

Di report wey dey go round na say di actress slim down well well recently, and e don make many people dey worry, dey talk up and down for social media.

For one recent gist wey she yarn with veteran actress Joke Silva, Mercy Johnson tok say she get one kind cancer scare and she do surgery to comot her thyroid.

She tok say:
“I bin get cancer scare and dem comot my thyroid. Na serious journey for me and my husband because we get children, and dat time my last born na just six months. Me and my husband dey tell ourselves say, ‘This one na our new reality, make we go do di surgery.’”

“When we reach hospital, dem tell me say I go dey take medicine for di rest of my life. Dem sit us down, dey tell me say I no fit miss my medicine, dem even explain di side effects. So this weight loss wey una dey talk, na di result of everything wey happen. I don reach that point wey I just accept say na here we dey now, make we move on from here and find peace inside this new normal.”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist