Skales Wan Collabo With Yinka Ayefele Drop New Jam
Written by YangaEditor1 on May 19, 2025
Skales Wan Collabo With Yinka Ayefele Drop New Jam
Afrobeats singer, Skales don join body with gospel/tungba musician, Yinka Ayefele for new jam, and e don announce say him album ‘Martina’s Son’ go drop, as ‘Shake Body‘ don blow again for TikTok with help from football star Lamine Yamal.
As di fire still dey hot, Skales don follow up sharp sharp, him don announce say him new album ‘Martina’s Son’ go drop soon.
Him make di announcement for him X page, where him post one video of him and gospel/Tungba legend Yinka Ayefele for studio. For di clip, dem dey sing to one new jam wey carry sample from one of Ayefele’s old school gospel bangers.
Di album don already dey get serious buzz before e even drop, all thanks to di way ‘Shake Body’ take trend again. Di song even catch attention of Barcelona 16-year-old baller Lamine Yamal, wey get over 26 million TikTok followers. Him dey use the song do dance videos wey don go viral.
As Skales dey appreciate how Lamine Yamal take help push the song again, him even drop new jam wey him call ‘Dance Like Lamine Yamal’.
This new energy from ‘Shake Body’ don make Skales reach 1 million monthly listeners for Spotify for the first time ever.
Na so TikTok don help many old songs shine again, and Skales na the latest person wey dey enjoy the spotlight.