Yanga FM 89.9

To Be Parent Na Serious Experience Wey fit Change Person Life – Johnny Drille

Written by on May 19, 2025

To Be Parent Na Serious Experience – Johnny Drille

Nigerian singer John Ighodaro, wey people sabi as Johnny Drille, don open mouth talk about how e feel to become papa.

To Be Parent Na Serious Experience Wey fit Change Person Life - Johnny Drille

To Be Parent Na Serious Experience Wey fit Change Person Life – Johnny Drille

Report bin talk before say di singer and him wife, Rima Tahini, welcome their first pikin — one baby girl wey dem name Amaris Esohe Ighodaro on November 17, 2023.

For one recent chat, Johnny Drille yarn say since e become papa, e don begin appreciate him mama and papa more.

E describe say to be parent na serious experience wey fit change person life.

“The one rule wey I dey live by na say family first. Anywhere I dey for this world, if my family need me urgently, I go drop everything and go meet them.

Family don always be my backbone. Anytime life choke me, na back to family I dey run go. And once I reach, everything go just dey alright. Dem always dey there for me especially my mama and papa.

My biggest dream be say I go fit take care of them well-well, and even carry them waka see better places for this world.

My parents no get plenty that time. I remember say e hard well sometimes — food no go dey, but dem go still find way provide something for us chop.

Dem just dey package everything make e fun for us. As small pikin, we no know wetin dey happen. But now as I don grow, I dey reason am say dem dey try protect us from all the wahala wey dey that time.

Now wey I don get my own pikin, I don understand wetin e mean to raise person. E dey sweet and e dey tough.

Right now, I dey appreciate wetin my papa and mama do for me and my siblings more than before. To get pikin dey change person life in ways wey words no fit explain.

And people no dey really talk about am like that. But I thank God say I get parents wey raise me well, especially for this kind wahala world, and help me learn how to manage life.”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist