Adunni Ade don warn say she go carry lawyer enter matter over fake tori wey dem put for her head
Written by YangaEditor1 on May 26, 2025
Adunni Ade don warn say she go carry lawyer enter di fake tori matter wey dem put for her head
Award-winning actress Adunni Ade don talk say she no ever yarn say na her fine face and popularity dey stop her from marry.

Adunni Ade don warn say she go carry lawyer enter matter over fake tori wey dem put for her head
One kind post wey dey everywhere for social media bin carry one talk talk wey dem say na she talk am – say she dey regret say she never marry despite say she fine and people sabi her well-well.
But sharp-sharp, Adunni Ade come clear the air say na lie dem lie, say the talk na pure packaging and make dem delete the post within 24 hours before she carry lawyer enter the matter.
For her post wey she drop for X, she vex say people dey use her name take find popularity for social media, and say the talk no come from any interview or correct media outlet.
She write:
“Abeg, make una pull down that post within 24 hours so wahala no go enter. I no dey happy say una dey use my name carry fake news wey no get head or tail just to get people attention.”
For her Instagram, she add:
“Trouble dey sleep, na yanga go wake am. Wetin you dey find? Na wahala you dey find, na wahala you go jam!”
She still remind dem say her last interview na for September 2024 for the film Tokunbo, and beg dem make dem no dey carry her name join social media gbege again.