Davido Para for Sarah Martins Over Chioma Restaurant Talk
Written by YangaEditor1 on May 27, 2025
Davido Para for Sarah Martins Over Chioma Restaurant Talk
Afrobeats superstar Davido don blast Nollywood actress Sarah Martins after she suggest say him new restaurant campaign suppose bear him wife Chioma Adeleke name.
Martins drop one post for Instagram as she react to Davido collabo with one food brand. She talk say she bin hope say the restaurant go carry Chioma name, instead of Davido album title.
“I feel say Davido suppose open the restaurant for Chioma or even name am after her, because we sabi say she sabi cook well well,” na wetin she write.
But Davido no take am easy. He reply her sharp sharp:
“U no get sense… No restaurant dey open. Na just promo campaign with @foodcourt_app for my album 5️⃣. Now comot my wife picture from your page.”
Him clapback scatter social media, as e go viral quick. Fans hail Davido for standing gidigba for Chioma and for shutting down wetin many people call “unnecessary talk” from Sarah Martins.