50 Cent Don React Say Dem Mention Him Name for Diddy Trial
Written by YangaEditor1 on May 28, 2025
50 Cent Don React Say Dem Mention Him Name for Diddy Trial
Popular American rapper, 50 Cent don react after dem mention him name for inside ongoing sex trafficking and racketeering trial wey concern him colleague, Sean Combs aka P. Diddy.
Diddy wey dem arrest for 2024, dey face serious court matter for New York say e involve for sex trafficking and other big big charges.
Plenty top celebrity names don drop for the testimonies wey people dey give against Diddy, as the trial don enter the third week.
One of the main people wey testify na Cassie Ventura, Diddy ex-babe, wey talk say Diddy abuse her both physically and mentally for 11 years (from 2007 to 2018).
Capricorn Clark, wey be Diddy former assistant, also testify. She talk say Diddy get list of people wey e no like among celebrities, and 50 Cent name show for the list, Say she hear Diddy dey talk about weapon when e dey talk about 50 Cent. She say Diddy tell one executive say, Him no like all this back and forth say na gun he like.”
As 50 Cent hear wetin dem talk for court say Diddy plan to harm am, e no waste time, he jump go Instagram go laugh Diddy small.
He talk say, Small Diddy wan finish am? he go just lay low, Say him dey reason to hide for playoff game tonight. LOL.
This one dey happen even after Diddy don deny before say e no get wahala or beef with 50 Cent.