Yanga FM 89.9

Yanga Service

Yanga Service

Yanga Service Presented by Obus


Info and episodes

Plenty Artists Dey Fake Online – Davido

Written by on May 28, 2025

Plenty Artists Dey Fake Online – Davido

Afrobeats superstar Davido, don talk why him be the most followed African artist for social media.

Plenty Artists Dey Fake Online – Davido

Plenty Artists Dey Fake Online – Davido

Davido talk say the reason why people follow am pass other artists na because him dey free and open with him fans.

According to am, many of him fellow artists dey fear to show who dem really be online.

Davido yarn say

Him be the most followed African artist for social media because he dey free with him fans and he talk say when he just start music, he open well, he dey do vlogs, dey show people how im life be. But many Nigerian and African artists dey fear to show their real self.

He talk say living in America help am too.

“Living in America help me too. My mind open small. No be say I dey call my people ignorant o, but make we see other artists take pictures for house with shorts and slippers. Dem no go gree. Dem go first change cloth wear something wey go make dem look like celeb. But me, I still see myself as normal guy. I dey take picture for slippers and shorts. But when e reach groove time, I dey turn up well!

“When I come move back come Naija, I observe say some celebs dey overthink everything. I just say, no need make person just dey chill. Follow the flow. Na so e suppose be.”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist