Nasboi Don Start 36-Day Begging Tour for Davido Feature
Written by YangaEditor1 on May 29, 2025
Nasboi Don Start 36-Day Begging Tour for Davido Feature
Singer and comedian Lawal Michael, wey everybody sabi as Nasboi, don launch 36 days nationwide beg-beg waka to get music collabo from Afrobeats king Davido.
Nasboi carry the matter go Instagram, announce say e go dey kneel down for each of Nigeria’s 36 states – one state per day and e start for Osun State, wey be both him and Davido hometown.
By Thursday, baba don reach Kano State, wey mark day two of the kneeling campaign. The guy dey beg for just one verse from the person wey him dey call “001.”
Nasboi write:
“For 2019, I start to dey mimic Davido just to take promote my music, but na the comedy part blow. (Na God plan be that.)
Now I don come back to beg 001. Abeg bless me with one verse for this jam, king.
I go kneel for 36 states for 36 days. I dey pray make this dream come true. As Nasboi fan, I beg, anytime you see my post, just tag @davido.
Day 001 – Osun State. 35 states remain.”
Nasboi first enter spotlight for 2019 with his skits titled “Low Budget OBO”, where e dey copy Davido voice and swag. Even though na music e wan chase, the videos push am enter comedy limelight.
Since then, e don act different roles like Akpan and Ikechukwu, but music still dey him chest. Songs like “Small Money,” “Short Skirt,” and the viral “Umbrella” with Wande Coal show say baba no give up on music dream.
Now, him dey kneel with hope say 001 go hear am.