Yanga FM 89.9

Yanga Service

Yanga Service

Yanga Service Presented by Obus


Info and episodes

Kizz Daniel Yarn Say ‘Lemon Chase’ Na From Heart, No Be Hype

Written by on May 30, 2025

Kizz Daniel Yarn Say ‘Lemon Chase’ Na From Heart, No Be Hype

Naija singer Kizz Daniel don open up say im new EP wey im name ‘Lemon Chase’ no be the normal way wey people dey do music business.

Kizz Daniel Yarn Say ‘Lemon Chase’ Na From Heart, No Be Hype

Kizz Daniel Yarn Say ‘Lemon Chase’ Na From Heart, No Be Hype

Im talk say this EP wey get seven tracks no be just small taste of the album wey dey come – ‘Uncle K’ – but na very personal work wey dey carry plenty emotion like love, loss, peace and enjoyment wey anybody wey listen go fit relate with.

Di Flyboi boss yarn say the koko of the whole EP na to dey real, honest, and true to imself.

“As life give you lemon, na to turn am to lemonade. I wan make this project be like real life — sweet, sour, e dey confuse sometimes but e still fine. Na music wey go touch your heart — whether you dey heal, dey hope or dey remember something. I just wan make am pure, real and make e show who I be,” na wetin Kizz Daniel talk be that.

Di EP carry big names like five-time Grammy winner Angelique Kidjo, Johnny Drille, Bella Shmurda, Odumodu Blvck, Zlatan and Fola.

Di lead single ‘Police’, wey get Johnny Drille from Mavin and Angelique Kidjo, don dey make waves already and music people dey talk say e fit enter for Best African Music Performance for next Grammy.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist