Lojay Say Headies Get Value for Naija Artistes Pass Grammy
Written by YangaEditor1 on May 30, 2025
Singer Lojay don talk why e believe say The Headies award dey more important to Naija artistes pass Grammy and other big-big international awards.
As e take yarn for recent interview, the Grammy-nominated artiste talk say make Naija artistes begin take local awards more serious, because all those foreign award people no go ever put Naija artistes first.
Lojay wey carry Best Male Vocal Performance for the 17th Headies talk say:
“As Grammy and all those international awards sweet reach, as Naija person, you no fit ever be their priority for place wey no be your own. Na just now we dey beg make dem even put Naija songs for Pop category for Grammy, songs wey be real pop. Tems do one of the best R&B albums last year, dem still carry give am Best African Music Performance.
“Why dem no talk about her for R&B, Pop or Best Female categories? Na because dem get their own people wey dem feel say deserve am and e dey okay like that. But wetin go really help me as Naija artiste na if Headies fit big reach the level wey American artistes go dey win Headies and go come Naija to collect am.
“I go love to see say one day Travis Scott go fly enter Naija for Headies award. Wetin I dey gain if Grammy dey bigger than Headies? We no dey gain anything if Grammy dey bigger, but if Headies blow, everybody go benefit.
“I believe well well for Nigeria. I believe say Nigeria fit better, fit strong. I believe say wetin we dey do fit go global. So we no suppose dey look our own thing like say e no reach. We gats respect and push our own.”