Yanga FM 89.9

Owanbe

Our African Sound

Our African Sound

Our African Sound


Info and episodes

Falz Talk Say E Fit No Raise Him Pikin for Naija  Because of Wahala

Written by on June 2, 2025

Falz Talk Say E Fit No Raise Him Pikin for Naija  Because of Wahala

Popular rapper and activist wey him name na Folarin Falana but people sabi am as Falz don talk say e fit no raise him pikin for Naija.

Falz Talk Say E Fit No Raise Him Pikin for Naija  Because of Wahala

Falz Talk Say E Fit No Raise Him Pikin for Naija  Because of Wahala

The This Is Nigeria guy yan say e dey get threat because of him activism, plus wahala wey dey for the country like insecurity and bad economy na why e dey think that kain thing.

Falz bin show for one recent episode of Dear Ife Series Podcast wey Ifedayo Agoro dey host.

The host come ask am:
“You go fit raise your children for Naija if you finally born?”

Falz come reply:
“Ah! That one na serious question o. I no even reason say you go ask me that kain thing. I never really think reach that side, make I no lie.

But na something wey I no fit just talk ‘yes’ to like that because of all the things wey we dey talk — insecurity, the threat because of my activism, and how Nigerians just dey carry eye see nonsense.

E hard to just open mouth talk ‘yes’. And e dey pain me. But I no fit also just talk ‘no’ because I dey support Naija well-well and I believe say e fit still better. But honestly, I no sabi, I no sabi… make we dey look [laughs].”

Falz never marry and him never get pikin for now.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist