Yanga FM 89.9

Tems Manager Don Talk Say Na Only $300 Naija Artistes Dey Make from 1 Million Streams for Naija

Written by on June 2, 2025

Tems Manager Don Talk Say Na Only $300 Naija Artistes Dey Make from 1 Million Streams for Naija

Tems manager, Muyiwa Awoniyi, don reveal say Nigerian artistes dey collect just about $300 if dem get one million streams inside Naija.

Tems Manager Don Talk Say Na Only $300 Naija Artistes Dey Make from 1 Million Streams for Naija

Tems Manager Don Talk Say Na Only $300 Naija Artistes Dey Make from 1 Million Streams for Naija

As he take talk for one recent episode of the Afrobeats Intelligence podcast, Awoniyi compare am with countries like Sweden, wey the same number of streams fit bring between $8,000 to $10,000.

Him say the big gap dey happen because music streaming subscription for Naija too cheap.

According to am, Spotify dey charge like ₦900 per month for Naija, wey be small compared to other countries.

Awoniyi still explain say the way dem take calculate streaming money na by territory, and that one dey put Naija artistes for big disadvantage globally.

Him talk say:

“You sabi how much dem dey pay for one million streams from Nigeria? Na just $300. But if na Sweden, the same one million streams fit give you between 8 to 10 thousand dollars.

For Naija, to subscribe to Spotify na ₦900.

Plenty people no sabi this thing. Spotify dey use territorial model. So if my IP (intellectual property) dey linked to country wey dem dey pay $300 for one million streams, I don enter wahala be dat.”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist