E Easy to Blow Now Pass How E Be for 2000s – Timaya
Written by YangaEditor1 on June 5, 2025
E Easy to Blow Now Pass How E Be for 2000s – Timaya
One of di OG musicians for Naija, Timaya, don yarn say to enter music industry now dey way easier pass how e be for 2000s to early 2010s, when him and him padi dem dey run things.
As e dey talk for one recent episode of Afrobeats Intelligence podcast wey Joey Akan dey host, Timaya wey people sabi as Egberi Papa 1 of Bayelsa talk say na because of digital technology and social media wey don change how music dey take happen for Naija.
“To do music now easy for all these new musicians pass our own time. Ahn ahn! That time, how you wan blow? Na only one person go get all the power,” na so Timaya take talk.
As him dey remember how him do that Odeshi song with Flavour, Timaya talk say dem face wahala because of music rights.
“We come find out say na Premier Music get the catalogue. We wan use ‘Can I Have A Dance?’ – who we go meet? Premier. We pay again.”
Timaya come compare that time with how easy e don be now:
“Now now, your papa or mama fit just buy you studio equipment. You go record one mad jam, register yourself, post am online – one TikTok sound and you don blow. Na just data you need.”
E come talk how hard e be that time to even hear your song for radio:
“Back then, before dem go even play your song for radio station, enh! Omo! Wahala full ground. Now, na from house you dey upload song. Very very fast to blow now. You fit just dey your house dey shout.”
Even though Timaya say e dey enjoy how the industry don grow, e still yarn say the new way especially all the posting and promoting online wey no too easy for am.
“I like am oh. But because I no start like that, e dey hard me. All this posting na stress. Sometimes I go reason say I no even need am. But na the business – I gats do am.”