Menu
Na you first carry Afrobeats go UK, Rema hail D’banj
Written by YangaEditor1 on June 9, 2025
Na you first carry Afrobeats go UK, Rema hail D’banj
Nigerian singer, Divine Ikubor wey everybody sabi as Rema, don hail Afrobeats legend D ’banj for di work wey e don do to help push Afrobeats go global level, especially for UK.
D’banj 2012 hit song, ‘Oliver Twist’, na di first Naija jam wey enter top 10 for UK official chart, and dat one na wetin open way for other Afrobeats songs to follow enter the chart.
As Rema bring D’banj come stage for him sold-out concert for London O2 Arena on Sunday, e talk say if no be D’banj wey first break into UK market, e for no fit blow as Afrobeats artiste for there today.
E talk say na D’banj clear road for plenty of dem wey dey now.
“First of all, I wan thank you for opening gate for us. We wey be new school artistes no do am alone.
“Na you be one of di first people wey carry Afrobeats enter UK. You and Don Jazzy really hold ground. Na una open dat door.
“I go dey appreciate you till forever. I love you well-well. If say you no exist, me sef for no exist,” na so Rema take talk.