Yanga FM 89.9

Owanbe

Our African Sound

Our African Sound

Our African Sound


Info and episodes

Ayo Animashaun Don Yarn Say Many Naija Musicians Dey Suffer

Written by on June 20, 2025

Ayo Animashaun Don Yarn Say Many Naija Musicians Dey Suffer

Oga wey start The Headies Awards, Ayo Animashaun, don open up say many Naija musicians dey suffer quietly, as na only small group of big artistes and record labels dey chop real money.

Ayo Animashaun Don Yarn Say Many Naija Musicians Dey Suffer

Ayo Animashaun Don Yarn Say Many Naija Musicians Dey Suffer

For one interview wey he do with Teju Babyface, Animashaun talk say even though music industry dey grow, most artists no get steady source of income. E say person fit blow before, but that one no mean say dem still dey cash out today.

According to am, many up-and-coming or lesser-known artistes no dey get show, and even when dem manage get one, the pay no fit feed better pikin — na just small change.

He talk say, “You fit see some wey dey live soft life, but many of dem just dey package, dey form say everything set, dey hope say one big break go show.”

Ayo come advice say make artists open eye and know where dem stand for the game. If e no dey work, make dem try other markets wey go appreciate dem pass, change strategy, or even find another hustle.

Him words: “Plenty artistes no dey make money. You go talk say artistes dey make money? You no fit even count ten wey dey truly make money for this Naija. Na the big names and like one or two record labels. The rest? Dem dey really struggle. I sabi many of dem – and na real struggle.

“This music industry wey una dey look say big, no be everybody dey chop from am. Some people don make money before, but e no mean say dem still dey make am now.

“As for streaming money for Naija? Na just peanuts, nothing dey there compared to outside country.

“How many shows the small artistes dey perform for? And if dem even perform, how much dem dey pay dem? So tell me, where the money suppose come from?

“The few wey dey ball, dem fit buy anything dem want. But many others just dey try look good, dey pray for better opportunity.

“So, yes, music business for Naija still dey grow. If na here you dey, you need understand your level. If e no dey work, try shift or go where people go value your sound and fit pay you well. Or you just park well, do another thing.”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist