Billboard Don Crown Stevie Wonder as R&B Number One
Written by YangaEditor1 on June 20, 2025
Billboard Don Crown Stevie Wonder as R&B Number One
Billboard don talk say na Stevie Wonder be the Greatest R&B Artist of All Time as dem drop list of top 75 best R&B musicians ever.
Dem say dem use things like voice power, how plenty the person songs be, how long dem don dey the music game, wetin dem achieve for industry, how dem change the game, and how their music still dey touch people generation to generation take judge.
Stevie Wonder carry number one spot. After am na:
-
Aretha Franklin – Number 2
-
Michael Jackson – Number 3
-
Beyoncé – Number 4
-
Whitney Houston – Number 5
Other big names wey follow for top 10 na: James Brown, Prince, Mariah Carey, R. Kelly, and Marvin Gaye.
Some other legends wey still show for the list be:
-
Ray Charles (11)
-
Usher (12)
-
Sam Cooke (13)
-
Curtis Mayfield (14)
-
Isaac Hayes (15)
-
Mary J. Blige (16)
-
Janet Jackson (17)
-
Al Green (18)
-
Smokey Robinson (19)
-
Otis Redding (20)
Our popular modern stars sef no carry last:
-
Chris Brown (26)
-
Erykah Badu (28)
-
Diana Ross (29)
-
Alicia Keys (33)
-
Babyface (35)
-
Toni Braxton (36)
-
Frank Ocean (37)
-
Brandy (41)
-
SZA (44)
-
Rihanna (46)
-
The Weeknd (47)
-
Lauryn Hill (48)
-
John Legend (50)
Na big win for R&B fans as Billboard don salute the true legends wey don shape the genre from back in the day till now.