Olamide No Dey Pick My Call After E Use My Name Sing – Yemi My Lover
Written by YangaEditor1 on June 20, 2025
Olamide No Dey Pick My Call After E Use My Name Sing – Yemi My Lover
Actor Yemi Ayebo, wey people sabi as ‘Yemi My Lover’, don yarn say musician Olamide no dey answer him calls after e use him name for one of him songs.
Yemi talk this one for one interview wey dey fly for social media.
When dem ask am whether musicians and skit makers dey pay am for using him name ‘Yemi My Lover’ for their content and music, the actor talk say nobody don ever give am shishi.
Him still talk say Olamide no pick him call for like six months, even though he try reach am through Fuji musician, Pasuma.
Yemi still yarn say the way people dey use him name for music and content don make am popular pass before.
“Olamide na the first person wey use my name for song, and that time I happy well well. My name carry grace, na why Davido, Olamide and other skit makers dey use am.
“One day, Pasuma ask me say ‘Yemo, Olamide don settle you for using your name?’ I tell am say no o, I never even see am before, talk less of settlement. We no even get each other number. Na that time Pasuma carry phone call am say I dey complain.
“Olamide come tell Pasuma make he give me phone make he talk to me. That na the first time we talk. He come tell me make I collect him number from Pasuma and make I dey call am.
“Pasuma give me the number, I call Olamide for more than six months, baba no pick, I send message tire, he no reply,” Yemi talk.
Watch the interview below:
https://x.com/Olamide0fficial/status/1935813293798551691?s=19