Yanga FM 89.9

Compound Wahala

Compound Wahala

Compound Wahala by Presented by Rugged Pastor & BabyLawyer


Info and episodes

Zinoleesky: Since my boy show, I don turn different person

Written by on June 23, 2025

Zinoleesky: Since my boy show, I don turn different person

Nigerian singer Oniyinde Azeez, wey people sabi as Zinoleesky, don open up say im life don really change since im born.

Zinoleesky: Since my boy show, I don turn different person

Zinoleesky: Since my boy show, I don turn different person

The music star welcome him first pikin, baby girl wey dem name Zendaya, for December 2023. E no even tey, he come born again, this time na boy, Zafar, wey land for April dis year.

As e dey yan for interview with Adesope Live, Zino talk say ever since he don turn papa, plenty things don change for him life. E say some bad habits wey him dey do before, he don mellow down because of him pikin.

“Fatherhood mean plenty tins to me,” he talk.
“Since my boy show, I don turn different person. Some things wey I dey do before, I no dey do like that again. I reduce plenty things just because of am.”

E still talk say e gats maintain focus now, make he no fall hand as papa.

“I gats calm down, arrange my head well. This papa life don be blessing for me true true.”

From street vibes to daddy duties — Zino don dey see life from new angle.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist