Genevieve No Dey Trend Again Because She No Dey Post – DeeOne Yarn
Written by YangaEditor1 on June 24, 2025
Genevieve No Dey Trend Again Because She No Dey Post – DeeOne Yarn
Controversial comedian and ex-BBNaija housemate, DeeOne, don talk say say some Nigerian celebrities like Genevieve Nnaji dey suffer small small because dem no too dey active for social media.
For one recent episode of Pulse’s Hot Takes podcast, DeeOne yarn say people wey no dey post steady for online no dey trend, and dem brand dey suffer because people go just forget them.
“Genevieve wey no dey talk or post for social media steady no dey help her brand at all,” he talk. “Make I rephrase am – anybody wey no dey post constantly no fit dey for top of mind.”
DeeOne even carry popular TikToker, Peller, come inside the gist to buttress him point.
“Wetin make Genevieve different from other actresses? Na number one since which year? As we dey talk now, Peller dey more relevant for internet pass Genevieve Nnaji,” he add.
The talk don cause gbas gbos online as people dey drag am say e no suppose compare legend like Genevieve with TikTok content creators.
But for DeeOne mind, if you no dey give social media content, you go gradually fade out from people mind for this internet generation.