I No Be Wizkid Wife – Shola Ogudu Warn Follower Over Fake Talk
Written by YangaEditor1 on June 26, 2025
I No Be Wizkid Wife – Shola Ogudu Warn Follower Over Fake Talk
Shola Ogudu, wey be Wizkid first baby mama, don reply one follower wey dey always call her Wizkid wife for social media.
She talk say di kain comment no dey make her happy at all, say e dey somehow and fit affect her badly.
Shola beg the person make dem stop to drop that kain talk, say normally she no dey respond to rumors or lies, but this one don pass boundary because e fit spoil her chance to become somebody real wife one day.
As she take reply:
“I no dey like address anything, whether na true or lie. But this kain comment wey you dey drop under all my posts fit affect me seriously from ever being ‘Iyawo Somebody’ in real life.
“To dey drop rubbish like this all the time no make sense. I really no like am at all. Abeg make this be the last time you go drop this your delusional comment. Thanks and God bless.”