Toyin Abraham Don Talk Wetin Make Am Leave Her Past Marriage
Written by YangaEditor1 on June 26, 2025
Toyin Abraham Don Talk Wetin Make Am Leave Her Past Marriage
Nollywood actress, Toyin Abraham don finally open up about her past marriage wey no work out with Adeniyi Johnson, as she yarn the real reason why dem separate.
Di actress wey marry her fellow actor for almost two years talk say her family no too gree for di marriage from beginning, but she no gree hear word.
She talk say her family even pray put and dem get warning from God say di marriage fit no last, but she waka go ahead still marry di guy.
For one interview wey she do with Ebuka Obi-Uchendu, Toyin come talk well well about her current husband, Kolawole Ajeyemi, wey still be her senior colleague for film industry. She talk say the relationship na better one wey dey full of understanding, love, and support.
She explain say na shared experience and faith make dem connect well, wey come later lead to marriage and dem don get two pikin – one boy and one girl.
Toyin talk say she really appreciate her husband and she dey happy say she find joy and fulfilment for di marriage.
She talk for di interview say,
“For real life, him dey very calm. Him be serious prayer person. Anytime I go Abeokuta, him dey always dey around. From there we begin close and later start to dey date. I no want make people sabi at first, but later I begin like am well well. Anytime him wan go work, I go follow am. As time go, I no send wetin people go talk again. I carry am go meet my parents, him carry me go meet him own. We do small introduction, I come get belle, na so marriage follow.
I come from Christian house, so my family pray about am and God show dem say na him be my husband. Now we don get two children – boy and girl.
Make una believe me, I marry one of the best. I no go talk say na the best, because I still dey look up to some other marriages like my godmother own, but my husband na one of the best.”
Na some of the reactions online be dis:
@omoajala yarn: “Hope dem tell you say this your present husband na the real one?”
@italianpizzasharwama talk say: “Na when person no dey hear God voice na im things go scatter.”
@omo_le_wa comment: “Hmm she don talk another story again o, I no go talk too much before her people come find me.”
@mimicklevel_elenu1 drop prayer: “Make God continue to keep una together.”
@damzchops talk say: “Di man mature well and him sabi life.”