Femi Kuti’s Son Blasts Blogs Over Tour Snub
Written by YangaEditor1 on August 19, 2025
Femi Kuti, Scatter 24 Shows for North America , Blogs No Gree Carry Di Story-Made kuti
Nigerian Afrobeat icon Femi Kuti just finish one mad 24-show tour for North America inside only one month. 63 years old and di man still dey perform like say him just start yesterday also giving fans pure energy, passion, and classic Afrobeat vibes.
From New York, to Chicago, Los Angeles, Toronto and more, Femi Kuti and him legendary band The Positive Force scatter everywhere dem reach. Every show na full house from people dance, scream, and vibe from start to finish.
Him Son, Made Kuti, Don Para: “If Na Bad News, Blogs Go Carry Am!”
Naso successful tour end, Femi Kuti’s son , Made Kuti, wey also be talented Afrobeat musician come enter social media to express him vex.
For one post wey trend quick for Instagram and Twitter, Made talk say:
“My dad, 63 years old, just finished 24 shows in one month. Not one single blog carried it. If it was bad news now, they would all be posting it like wildfire.”
Based on say the post cause serious reaction online as fans support am, saying say Naija media too dey focus on negative gist instead of celebrating legends wey dey make Nigeria proud for international level.
Some people even mention say if na scandal or wahala, headlines go full internet sharp-sharp.
Why Dis Matter Plenty
People don begin ask big questions:
-
Why blogs no celebrate Femi Kuti’s hard work and success?
-
Why good news no dey trend like bad news?
-
Wetin bloggers really dey promote?
This na reminder say we gatz support our legends when dem still dey alive and active. Femi Kuti don carry Nigeria name far, wey e still dey represent Africa with pride.
Social Media Still Show Love
Sake of say Even if blogs no carry am him fans no let am die down. Hashtags like #FemiKutiTour2025, #AfrobeatLegend, and #SupportGoodNews dey trend for X (Twitter), Instagram, and TikTok as people begin post videos and photos from di shows.
People dey hail di Kuti family for how dem dey keep Afrobeat culture alive and global.
What’s Next for Femi Kuti?
Reports dey say after this tour, Femi go return Nigeria for some rest and maybe begin work on new music. People dey expect collaboration with Made Kuti and other international artists.
With how di Afrobeat wave dey rise based on say Femi still dey among di top voices wey dey shape di future of African music.