Yanga FM 89.9

Biggie Crown Faith as New Head of House

Written by on September 2, 2025

Faith Don Win Head of House,Na Him Time to Shine!

Faith Show Strength, Carry HoH for Di Week

Big Brother house don get new Head of House, and na Faith wey carry am this time. Di competition no easy at all, but Faith stand strong from beginning to end.

Biggie Crown Faith as New Head of House

Biggie Crown Faith as New Head of House

As Biggie announce am, housemates shout, clap, some even open mouth. Nobody really expect say Faith go win, but the guy prove everybody wrong.

From Underdog to Top Dog

Before now, many people dey look Faith like underdog. E dey quiet, dey observe. But this time, he shock dem all.

“I just keep calm, focus and tell myself say I must win today,” Faith talk after di task.

Now, with this win, Faith don get immunity, better room and small power to run things inside the house.

Privileges Weh Follow Head of House

As HoH, Faith go enjoy:

  • Luxury lounge stay

  • Power to pick three BFFs

  • No eviction wahala this week

  • Authority for some house decisions

For BFFs, he choose Chika, Jayboy, and joanna naso all of dem dey happy to join am flex inside the luxury room.

Other Housemates Dey Watch Am Close

Some housemates clap for am genuinely. Others just dey look. As Head of House, all eyes go dey on how Faith go take lead this week.

Biggie also announce say dis week wager task go tough, and food depend on am. So Faith gatz balance fun with leadership.

Online People Dey React

As usual, social media scatter once dem hear say Faith don win.

@TeamFaithOfficial: “From lowkey to leader. Na our guy be dis!”
@BBWatchQueen: “Make he use am well oh. Power sweet but e heavy too.”

Plenty fans happy say new face don finally show pepper.

Wetin Next?

Dis week, game go change as Faith dey in control. Eviction nominations dey come, and housemates gatz dey sharp. One wrong move fit scatter Faith reign or make am shine brighter.

Make we watch as di week unfold.

Tagged as

Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist