Yanga FM 89.9

Compound Wahala

Compound Wahala

Compound Wahala by Presented by Rugged Pastor & BabyLawyer


Info and episodes

Mohbad DNA Saga: Court Drops Final Order

Written by on September 3, 2025

Court Don Order DNA Test for Mohbad Pikin

 Life, Music And Gist Before DNA Wahala Start

Mohbad, wey him real name na Ilerioluwa Oladimeji Aloba, na one fast-rising Nigerian artist wey capture many hearts with songs like Peace,” “Feel Good,” “Ask About Me,” and plenty others. Him start music hustle under Marlian Music, but later waka on his own. People sabi am for him deep lyrics and street vibe. Sadly, Mohbad kpai for September 2023, and him death come with plenty controversy. Since then, tori no gree finish , from cause of death to family palava, and now , DNA test for him son.

Court Don Order DNA Test for Mohbad Pikin

Court Don Order DNA Test for Mohbad Pikin

Court Don Order DNA Test for Mohbad Pikin

As di matter dey hot, court don finally yan say make dem do DNA test to confirm whether Mohbad na true papa of di boy wey him wife, Wunmi, born  Liam Aloba.

Di DNA wahala don dey circulate online for months, but now court don stamp am. Na big step to finally clear di air.

Why Dem Wan Run DNA Test?

After Mohbad die, some of him family people begin talk say dem no sure if di pikin really be Mohbad own. Some even accuse Wunmi of hiding things. Online people join mouth sef  everywhere scatter.

So now, court don enter. Dem talk say, “No more stories na make test prove di truth.”

Who Carry Di Matter Go Court?

Him one person wey still remain private carry di case go court say dem need DNA test. Di person say no be to drag pikin up and down  make science talk true. Di aim na to settle everything legally and bring peace come both sides.

Nigerians Don React Online

As court drop di order, Nigerians no keep quiet. Social media don full with takes from  Twitter, Instagram, Facebook, even WhatsApp groups.

Some dey support am. One person for X talk say:

“As court don yan, make everybody rest. We go know whether Liam na truly Mohbad son. No more guesswork.”

Others dey ask why court involve, say make Mohbad rest in peace. But majority dey happy say matter go soon clear.

Wetin Go Happen Next?

Now wey court don talk am, di DNA test go soon happen. Di result go determine everything , whether Liam na true son or not. Di result go likely affect who go get custody, inheritance and even public opinion.

Make you siddon dey watch. We go bring update as e dey hot.

Tagged as

Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist