Yanga FM 89.9

Presented by Suo, MC Advice

Yanga Sports

Yanga Sports

Yanga Sports by Presented by Suo, MC Advice


Info and episodes

“Niniola Clear the Air on Marriage Talk”

Written by on October 24, 2025

Niniola Talks Marriage ,confim she dey cook with teni .

Afro-house queen Niniola don finally open up on her love life, music journey, and the talk wey people dey carry about her and her sister Teni. She yarn all these things for her recent interview with Yanga FM, and she no hold back at all.

“Niniola Speak on Love Life & ‘Bele’”

“Niniola Speak on Love Life & ‘Bele’”

Niniola Clear the Air on Marriage Rumors

For some time now, gist don fly say Niniola don marry or dey plan wedding secretly. But the “Maradona” crooner don finally set the record straight. She talk say make people no rush her matter as she never marry yet.

“I never marry o, abeg make una calm down, and i don old so i fit talk wetin i want and yes i never marry oh abeg ,” Niniola talk with small laugh.

She still explain say she dey focus more on her music and personal growth now, but she no rule out marriage for the future.

About Her New Single ‘Bele’

As she clear the air on the marriage talk, Niniola also take the chance to talk about her fresh single Bele”, wey don begin make waves online. She describe the song as a mixture of love and groove plus something wey fit make you feel good even when love dey sweet you.

“Bele na that kind love song wey go make you smile and still dance. I just wan give my fans something wey go lift their mood,” she explain proudly.

She thank her loyal fans for still standing by her since her breakout hit ‘ginger me(Alum)’, and she promise to keep serving better sounds.

Why She Never Drop Collabo With Teni

Many fans don wonder why Niniola and her sister Teni never drop one serious collabo despite both of them being big names for the industry. When the question pop up, Niniola no dodge am.

“business na business and at the right time e go drop gbagbe,” she reveal.

That one alone don make fans begin look forward to the day both sisters go finally bless our speakers together.

More Music, More Surprises

Before she round up the interview, Niniola talk say she still get plenty surprises wey go drop soon plus new visuals, new sounds, and maybe an EP before next year.

“I dey work non-stop. I just want make people dance, love, and enjoy good music. Na wetin dey move me,” she talk confidently.

Final Gist

Niniola don clear marriage rumors, drop her sweet new single ‘Bele’, and reassure fans say collabo with Teni dey on the way. For now, she dey focused on giving us good music and positive vibes.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist