Yanga FM 89.9

Presented by Suo, MC Advice

Yanga Sports

Yanga Sports

Yanga Sports by Presented by Suo, MC Advice


Info and episodes

Wizkid Pikin Don Show Talent, Fans Dey Lose Mind!

Written by on October 27, 2025

Wizkid Pikin Bolu Don Drop Music Snippet – Internet Scatter!!!

Bolu Don Enter the Music Scene -make una clear road .

E be like say music really dey the bloodline, as Wizkid pikin, Bolu, don finally show small sample of him own sound. The young star post one short music snippet online, and since then, social media never calm down.

Fans don dey talk left, right, and center as some dey praise him confidence and melody, others dey shout say the boy don inherit him papa’s “Starboy” genes.

Starboy’s Son Don tease new Music

Starboy’s Son Don tease new Music

Fans Dey Vibe With the Sound

From the small clip wey circulate, Bolu’s song get one cool Afro-soul feel, mixed with that calm Wizkid-type groove. Many people for X (Twitter) and TikTok don begin use am for background sound already, saying “this small boy sabi!”

One fan even tweet say, “Na this kind nepotism we like , talent plus connection, e go still make sense!”

Internet Dey Catch Fire

The post don gather thousands of views and comments within hours. Some people dey amazed at how bold Bolu be to start early, while others dey predict say e go soon drop full single

Influencers and celebs sef don join the talk. One popular podcaster yarn say, “If Wizkid fit raise this kind sound from him pikin, e mean say music no go finish for that family.”

Nepotism We No Mind

Normally, people no too like talk of nepotism, but this one sweet everybody. Many fans dey talk say if all celeb pikin fit deliver like this, make dem continue! Because Bolu’s vibe no just depend on name  the boy get real talent.

Even though the snippet never reach one minute, the melody and lyrics already show say Bolu get potential to carry the Starboy legacy go another level.

Wetin Next for Bolu Starboy

For now, Bolu never confirm if he go release full song soon, but from the way fans dey beg for “drop date,” e sure say something big dey come.

One thing clear be say the boy don make internet talk, and the sound sweet enough to make people believe say Starboy Junior go soon take over.

Na talent, vibe, and small dose of sweet nepotism wey everybody love. Bolu don enter, and the future don already dey sound good!


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist