DJ Tunez Punch Odogwu — Wahala Burst
Written by YangaEditor1 on April 7, 2026
Burna Boy And DJ Tunez cause kasala For Obis House start Serious Palava
Nobody enter Obis house on Monday think say dem go see this kind drama. The plan was to enjoy, chop, drink, shake body small . Then kasala burst like transformer wey don carry light for three years and now the whole internet don turn detective.
How The Yawa Start
So here na how the gist go. Burna Boy waka enter Obis house, and before the man even settle, e don dey eyeball DJ Tunez. Wetin dem talk? Nobody don yarn that part yet. But next thing Burna shove the DJ. And DJ Tunez? E no be the type wey go collect shove like birthday gift. E punch Burna Boy for mouth. Clean. Direct. No apology.
Odogwu receive fist for front of people. For party. On Monday. The ancestors were not consulted.
PA Enter, Try Do Oga Behavior
Now this na where sense nearly show face. Burna’s PA God bless that man’s liver him manage to drag Burna away from the wahala and escort am back to the car. Everybody breathe. Maybe the night go survive. Maybe tomorrow nobody go remember anything. Then Burna comot from the car. Come back With full chest.
Bodyguards Carry Last
E no come alone this time o. Burna return with im bodyguards the kind wey no dey smile for photo, wey dey crack knuckle as hobby. And those ones handle DJ Tunez the way agberos handle somebody wey no pay toll. The beating wey DJ Tunez receive? Multiple sources call am merciless. No be small slap. No be warning. Na the full invoice, with interest, VAT inclusive.
So make we count am proper, DJ Tunez draw first blood with fist to Burna mouth. Burna regroup, return, and send bodyguards to collect everything with compound interest. Obis house wey suppose be enjoyment zone turn to UFC arena before 10pm on a Monday.
The Real Gist Never Comot Yet
The part wey everybody wan know be say wetin cause the first shove and that one still dey find im way out. Something happen before everything scatter. Words? Look wey land wrong? Somebody step on somebody’s limited edition sneaker? We no sabi yet.
But e dey come. Because this na naija social media ,small time before tomorrow morning, somebody’s aunty wey dey stand near the fridge go don give full interview, voice note go don leak, and three different people go don claim say na them settle the fight.
