Yanga FM 89.9

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija


Info and episodes

I No dey hide My marriage, I no Just like wahala – Ruth Kadiri

Written by on July 7, 2025

I No dey hide My marriage, I no Just like wahala – Ruth Kadiri

Popular Nollywood actress, Ruth Kadiri, don finally open up about why people no dey see her husband, Mr. Ezerika, for public.

I No dey hide her marriage, I no Just like wahala - Ruth Kadiri

I No dey hide my marriage, I no Just like wahala – Ruth Kadiri

For one interview wey she do for the Dear Ife Podcast by Diary of a Naija Girl, Ruth talk say she no dey hide her marriage – she just no like wahala.

According to her, even though people think say her marriage dey coded, e no be like that at all. She talk say her husband dey always support her and dem dey go plenty events together.

“We dey go church together, we dey attend events together, my life no even private like people dey think. Any event wey I dey organize, my husband dey always show.”

She come still add say the man no just like too much spotlight. E prefer make e stay lowkey. Ruth say she no understand why people dey expect her to dey flaunt her marriage online.

“Make I clear una  – i no dey hide my husband. People wey sabi me, sabi am. And for me, that one don do. I no need siddon dey try prove anything.”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist