Gideon Okeke: “Jim Iyke Must Return $2.5M for Trash Movie!”
Written by YangaEditor1 on August 4, 2025
Na serious gbege wey dey unfold for Nollywood this time as popular actor Gideon Okeke no hold back to express him real thoughts about Jim Iyke latest movie wey Amazon Prime pay $2.5 million to show. According to Gideon, that movie no just bad, e trash well well, and e dey shame Nollywood. He even talk say Jim Iyke suppose return that big money because the film no deserve am!
Wetin Gideon Talk?
For recent post , Gideon no carry last. He talk say Nollywood dey grow, but people suppose dey serious about quality. E talk say:
“ Jim Iyke movie na dead on arrival also talk say $2.5 million no small money, and if the movie no satisfy viewers, Jim Iyke gats refund the money because na waste.”
This kain talk dey raise eyebrow because normally people dey ginger and support their colleagues, but Gideon come dey straightforward like gbege.
Why E Talk Say The Movie Trash?
Plenty people for social media don dey yan say the movie plot no clear, editing dey scatter, and acting no gree land well. Some fans talk say the story no get head or tail. Even some Nollywood critics talk say the movie no meet expectation.
So, Gideon stand gidigba to say if you pay millions to produce film, e suppose dey top-notch even say no be to dey embarrass the industry.
Jim Iyke Response?
Till now, Jim Iyke never respond officially. But fans dey wait to see if e go reply or even defend the movie. You sabi say Jim Iyke na one of Nollywood big names, and this kain talk fit affect am seriously.
What This Mean for Nollywood?
This whole drama show say Nollywood need to dey serious about quality over quantity. With streaming platforms like Amazon Prime dey pay big bucks, producers and actors gats step up their game. No be just to dey release film to collect money, but to dey deliver content wey go make audience proud.