Yanga FM 89.9

Owanbe

Our African Sound

Our African Sound

Our African Sound


Info and episodes

Danboskid & Ibifubara Evicted in BBN Shocking Twist!

Written by on August 12, 2025

Danboskid, Ibifubara Don Comot House – BBN Season 10 Hot Eviction Wahala

Naija, how far? Gbege don happen for Big Brother Naija Season 10 . Danboskid and Ibifubara don carry their bag commot from Biggie house!

Danboskid & Ibifubara Evicted in BBN Shocking Twist!

Danboskid & Ibifubara Evicted in BBN Shocking Twist!

The whole thing start after Biggie announce one crazy twist ,him  say 27 housemates go dey up for eviction after everybody fail to find one special immunity card wey dem hide inside the house. Omo, tension full ground that day!

As the eviction show kick off, fans begin para online. Twitter/X, TikTok and Insta scatter with #BBNEviction, #DanboskidEvicted, and #IbifubaraGone trends as people dey shout say this one na serious shake up.

Why Dem Evict Danboskid and Ibifubara?

Biggie no dey joke this season oh. According to the votes wey come from viewers across Nigeria and beyond, Danboskid and Ibifubara na the two housemates wey get the lowest fan votes. Even though dem try well-well for tasks and gist them still   no reach to save dem from eviction.

Danboskid don become fan fave for him dance moves and cruise vibes,  meanwhile Ibifubara dey known for her calm mind and smart gameplay. But this na Big Brother Naija, anything fit happen!

Wetin Next?

Furthermore  as the remaining housemates still dey recover from the eviction shock, fans dey already dey vote like mad for their faves. This eviction don shake things and  anybody fit go next!

Fans React Online

  • “How Danboskid go comot like that? Na him dey give us joy for party nights!”  @BBNFanQueen

  • “Ibifubara deserve to reach Top 5, this eviction pain me!”  @IjawGurl4Life

This eviction na clear reminder say for BBN 2025, every vote matter.Also if  your fave still dey house, begin vote now before e too late!

Make You No Miss the Gist!

For more BBN Season 10 updates, eviction news, and live reactions, follow us for every gbas gbos inside Biggie house!


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist