Davido Don Yarn How Him Papa Help Am For Early Days of Him Music Career
Written by YangaEditor1 on May 28, 2025
Davido Don Yarn How Him Papa Help Am For Early Days of Him Music Career
Nigerian superstar Davido don open up how him papa, Dr. Adedeji Adeleke, help am for the early days of him career.

Davido Don Yarn How Him Papa Help Am For Early Days of Him Music Career
According to Davido, when he just drop ‘Dami Duro’ as 17-year-old and blow, one record label bin give am contract wey worth $200,000 (about 300 million naira that time).
Davido yarn say:
“Na so my papa find out say person don give me $200K sign contract. E no waste time, e call dem, return their money and cancel the deal sharp-sharp.”
He talk say even though him papa be billionaire, e no like make him dey owe person or dey tied to any bad contract, but that time, Davido bin dey feel say him papa no wan support am.
“I bin dey feel say, you be billionaire and you no wan give me money. So I come dey find my own way,” Davido talk.
Him come thank God say the papa cancel that deal, because if not, e for still dey inside the contract up till two years ago.
One of the investors for that early contract, businessman Tosin Ashafa, even talk the story again for him X (Twitter) page, say na true Davido papa buy am out of the contract.
For the same interview, dem ask Davido to choose between him ‘A Good Time’ tour and ‘Timeless’ tour. Him pick ‘Timeless’, say na big moment for am as e take share him music with fans for sold-out arenas worldwide.
Davido also don announce him new ‘5 Alive’ tour, wey go start soon. The tour get 13 confirmed dates, including the 60,000-capacity Tottenham Hotspur Stadium for UK, wey him go perform with 50 Cent and Mary J. Blige.
For Canada, Davido go stop two times for Scotia Bank Arena (19,000 capacity) and Place Bell (10,000 capacity).
The main leg of the tour go happen for U.S., with 10 shows including State Farm Arena for Atlanta and Barclays Center for Texas.
For the tour, Davido go perform plenty of him hit songs, including jams from him latest album ‘5ive’, wey drop April 18, 2025. The album get 17 tracks and feature collabos with top international artists.