Yanga FM 89.9

Presented by Suo, MC Advice

Yanga Sports

Yanga Sports

Yanga Sports by Presented by Suo, MC Advice


Info and episodes

E No Make Sense When Artiste Just Dey Sign Another Artiste Just to Show Say E Don arrive – Simi

Written by on June 9, 2025

E No Make Sense When Artiste Just Dey Sign Another Artiste Just to Show Say E Don arrive – Simi

Nigerian singer, Simisola Kosoko, wey people sabi as Simi, don talk her mind about di new style wey big artistes dey open record label to sign upcomers.

E No Make Sense When Artiste Just Dey Sign Another Artiste Just to Show Say E Don arrive – Simi

She yarn say she fit mentor up-and-coming musicians, but she no too support di idea say artiste go just sign another artiste just to mark level for him career.

As she dey talk for one recent interview with VJ Adams, Simi talk say di record label business suppose dey for people wey sabi di work wella.

She talk say, “I fit sign artiste o, but e no too make sense when artiste just dey sign another artiste just to show say e don arrive. Because to di person wey sign, na just something wey e like do, e no really get solid purpose. But at the end of the day, na dem life be dat.

“I feel say na only people wey get true passion for music business suppose dey sign artiste.

“Because whether di artiste dey blow that time or e never blow, dem go still believe in am. Even if that song wey you feel say go burst no burst, you go still dey motivated to push am?

“You go gree stand gidigba with am? Because na person life be dat. Na im dream. And na so I dey see myself that time wey dem sign me – I dey wonder say, ‘How una dey see me? Na just milestone for una or e really mean something give una like e mean give me?’

“Na why I talk say I fit [sign artiste], but I no sure if I get that kind passion, if I get that fire to carry person reach finish line, if I fit dey give that energy steady. Because e dey take plenty.”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist