Peter Okoye Don Vex, Call Out Him Brothers Paul and Jude Say Dem Wan Spoil Him Name
Written by YangaEditor1 on June 5, 2025
Peter Okoye Don Vex, Call Out Him Brothers Paul and Jude Say Dem Wan Spoil Him Name
Peter Okoye, one half of the former P-Square duo, don carry him vex go social media to para for him brothers, Paul and Jude. He accuse dem say dem wan spoil him name on purpose, especially as dem dey drag each other for court now.

Peter Okoye Don Vex, Call Out Him Brothers Paul and Jude Say Dem Wan Spoil Him Name
According to Peter, wahala start when Jude lawyer talk for court say Peter lie for one statement wey he submit give EFCC about the case wey concern music royalties.
For Instagram, Peter drop plenty posts, claim say na Jude publicist dey behind the whole plan wey dey try paint am like say he be liar.
Peter no hide him vex, he talk say he no go try be the “bigger person” again like before.
Him talk say:
“Na exactly wetin I dey talk be this – their publicist dey do everything make I look like liar. I no be May D, I no be Cynthia Morgan, I be Peter Okoye! The one and only Okwute of the Okoyes! Las las, truth go show.
Una thief or una no thief?”
Peter also talk say the way Mohbad matter take end open him eye – say e make am realise say to keep quiet no be the way forward again.
He talk say:
“After I watch all the things wey happen to Mohbad and how the matter take play out, I swear I talk say I no go ever try be the ‘mature’ one again. Na that ‘bigger person’ act put me for this kind wahala. Omo! Never again!”
He still yarn say that 2021 P-Square reunion wey fans dey celebrate, na setup – say dem just use am.
“Na now I find out say I bin dey used for that November 2021 reunion. But since we don carry matter go court, I go wait for the right time to talk the full gist,” he add.