Yanga FM 89.9

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija


Info and episodes

Benue People No Need food, Na insecurity Dey Worry Dem – VeryDarkMan

Written by on June 20, 2025

Benue People No Need food, Na insecurity Dey Worry Dem – VeryDarkMan

Popular guy wey dey fight for people, VeryDarkMan don drag billionaire pikin Kiddwaya wey dey beg we country people to send money to help people wey suffer for recent attack wey sele for Benue.

Benue People No Need food, Na Insecurity Dey Worry Dem - VeryDarkMan

Benue People No Need food, Na Insecurity Dey Worry Dem – VeryDarkMan

If una remember say Kiddwaya share one post for X (Twitter) wey he dey ask people make dem donate money for the affected community. But the post make people vex well well, so Kiddwaya come delete am.

VeryDarkMan say e funny how person wey dey always show off him money, suddenly dey beg poor people for cash. E question why Kiddwaya no use him own money support the people if e really care.

He talk say, “The first thing you for do na to write one correct letter, then drop your account number. How you go sabi wetin Benue people need if you never even go there? You just dey your corner dey write nonsense come drop account number.”

“I happy say Nigerians call you out well well until you delete the post, e sweet me. Because na you be guy wey like show say you get plenty money. Every time you dey flex your wealth like say you better pass every Nigerian.”

VeryDarkMan still warn NGOs wey fit try take advantage of the Benue crisis dey collect money to buy food. He talk say the real wahala for Benue no be hunger but insecurity.

He suggest say e go only drop him NGO account if community leaders fit organize defense groups and get arms permission from Inspector General of Police.

He talk, “To all NGOs wey want use Benue matter collect money, Benue people no dey hungry. Government go give una money to bring rice, beans, garri, but the people no need food, na insecurity dey worry them.”

“If the local community leaders fit come out, form vigilante group, write Inspector General of Police say dem need arms, and IG approve am, na that time I go drop NGO account, make everybody contribute even if na 5 Naira.”

“This matter no be to just dey talk and do nothing, e serious, everybody suppose do their own.”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist