Yanga FM 89.9

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija


Info and episodes

“From Music Legend to Husband: 2Face Idibia’s Secret Wedding Finally Revealed!”

Written by on July 30, 2025

Gobe as 2Face Idibia Don Marry New Bae, Natasha Osawaru for Abuja !

Naija music legend, 2Baba (formerly known as 2Face Idibia), don cause major buzz online as he tie the knot with him new lover, Natasha Osawaru, for inside Abuja over the weekend.

“From Music Legend to Husband: 2Face Idibia’s Secret Wedding Finally Revealed!”

“From Music Legend to Husband: 2Face Idibia’s Secret Wedding Finally Revealed!”

The quiet but classy wedding wey happen for one private venue inside Maitama shock fans and even fellow celebrities, especially as the award-winning singer bin cause rukos as he been just separate from him partner of ten years Annie Idibia .

Who be Natasha Osawaru?

Natasha no be small fish o. She na politician for her constituency there for edo state ,wey dey known for her fine-tuned elegance and brains. she don some major  work for her constituents for edo state  based on say she be real law maker .

Dem say she and 2Baba don dey close for months, but based on say him been dey married to him ex wife of 10 years, as that ship scatter naso him come introduce am as him lover

Social Media Reactions  Wahala No Dey Finish

As the photos and video snippets begin fly enter social media, fans and critics begin drop hot takes:

  • Some dey congratulate 2Baba say he don find peace and happiness again

  • Plenty fans dey talk say e shock them wella, but dem go support true love any day

One Twitter user talk say:

 “Why my legend the rush like this??? E no fit a little break from women affairs, u just come out of one wife u just rush go marry another one. Can’t u live without women. Na wa ooo.”

Another Instagram comment read:

“Na who dey make you smile you suppose marry. Congrats 2Baba & Natasha .”

Wedding Vibe but lowkey 

No be many celebs show face, but close friends and family dey present. The mood na mix of love, class and deep vibes. No noise, no paparazzi na just real vibes and serious commitment.

Wetin Happen to Annie Idibia?

Many fans still dey drag matter online as dem dey ask questions about Annie, 2Baba’s long-time love and baby mama turned wife.

Until press time, Annie never drop official statement, but her recent Instagram story  a simple black background with the word “Silence.”  she don add fuel to the fire.

We dey follow up the matter close, and once we get more confirmed info, we go bring am straight to una.

Final Tori

For now, e clear say 2Baba don move on with Natasha, and the internet no go calm down soon. Whether na true love, midlife reset or social media cruise, only time go tell.

But one thing sure be say  2Baba don enter new season, and fans worldwide dey glued to the gist.

Tagged as

Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist