Menu
Compound Wahala
Compound Wahala
Compound Wahala by Presented by Rugged Pastor & BabyLawyer
Info and episodes
Two housemates, Denari and Tracy, don chop eviction for di Big Brother Naija house dis Sunday. As di tension high, Ebuka no waste time before e call dia names, and just like dat two of them gone!
Denari and Tracy waka commot di game after dia fans no fit gather enuf votes to save dem. Dis na di latest twist wey shake di house and turn di game upside down.
During di Sunday live show, housemates sidon with shaky belle as Ebuka start di eviction matter. Afta suspense full di air, he first call Denari name. Just when di crowd still dey process am, Tracy name follow.
Everybody shock. Some housemates even cry small most especially those wey dey close to dem.
As e be for BBNaija, na fans dey decide who go stay or go. Di two evictees no get enough support from viewers. People for street talk say:
“Dem no too show themselves for di house. Others dey bring drama, Denari and Tracy just dey blend.”
Another fan talk say,
“Tracy try, but maybe people no connect with her like dat.”
As usual, fans don carry matter go social media. Some dey vex say their fave don go, others dey talk say di eviction fair well-well.
One X (Twitter) user yarn say:
“Denari na cool guy, but BBNaija no be for soft play. You gats loud yourself!”
Another fan write:
“Tracy get potential, but she hide too much. House no be for hide-and-seek.”
Even though dem don comot, di journey never end for both of dem. Most ex-housemates dey use di platform blow for music, movies, fashion and more. People go dey watch to see wetin Denari and Tracy go use di fame do next.
With two people don waka, di game don tight more. Alliances dey shift, new gbas-gbos dey cook and everybody dey watch who go be di next victim.
Make una stay tuned for more BBNaija gist. E be like say dis season go hot till di last day!