No pity role for James Brown – Papaya Speaks
Written by YangaEditor1 on December 17, 2025
PapayaEx Opens Up on Casting James Brown in Her Movie The night market .
By ;Ezurumem Obinna praise
Influencer and filmmaker Papaya don finally talk about why she feature James Brown in her latest movie. For a recent Yanga FM interview with Jaycee, she spill the real reason behind the casting and address rumors about James Brown’s career. Based on say recent claims have shown that he no even fit go the school for london wey him say him dey attend rumors say him don broke .Other news sef show say him no even get house as a viral video show where them throw him things. Rumor sef say them don blacklist am but she say nothing like pity pay .
“I No Dey Revive Him Career”
Jaycee ask Papaya Ex if she dey try revive James Brown career, since e be like say e don fall off. She quickly clarify, saying no be so.
According to her, just because people no dey post about someone no mean say nothing dey happen for their life. She explain say casting James Brown no be charity or comeback move say na professional decision for her film.
James Brown Deliver Perfectly
Papaya reveal say, as she dey plan the movie, she need more actors to fill certain roles. She call James Brown, and he deliver well, proving say e still get talent and professionalism.
She also address viral reports wey claim say James Brown don lose him house and dey near fall off, stressing say those stories no dey affect her decision.
Focus on Talent, Not Rumors
The influencer make am clear say her priority na finding the right people for the right roles, not to hype anyone’s career. By featuring James Brown, she showcase talent while keeping her project quality high. Papaya story show say smart casting na about skill and fit, not gossip or social media noise. Fans fit expect solid performance from James Brown in her latest film.
