Yanga FM 89.9

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija


Info and episodes

Samuel banks : I No Know Dem Be Billionaire!

Written by on January 26, 2026

Arike Don Yarn How E Take Meet Okoya  Pikin Them: “I Swear, I No Know Who Dem Be”

By: Ezurmem Obinna 

Popular Naija content creator Samuel Banks, wey everybody sabi as Arike, don finally open mouth talk about how e take become padi with the Okoya brothers wey be pikin to one of the  richest family for Naija.

“Na Dem First Reach Out to Me O”

For one interview wey e grant Yanga FM wey don dey shake social media, Arike don shut down all those tori say e dey chase clout by dey follow billionaire pikin them.

“Abeg o, no be clout I dey find,” The comedian talk am clear clear. According to wetin e yarn, na di Okoya brothers see im skits for online first, and dem come slide into im DM say dem wan collaborate. But wait o ! Arike talk say him  no even sabi who dem be!

The Koko Wey Shock Am

Di moment wey reality come hit Arike na when e reach their house for di first time. “Mehn, I no know say na billionaire pikin I dey go meet until I reach their crib,” e confess for the interview. The  skit maker talk say e just dey look around like person wey lost, as e finally understand the kind mula level wey e just enter.

E Wan Set Di Record Straight

But as Arike don yarn am now, The matter no be like dat at all. Na through im social media DM the collaboration request enter, and The  brothers genuinely like him comedy content. Dat time sef, Arike just see am as normal collaboration him  no even google who dem be.

Samuel Banks on meeting billionaires

Samuel Banks on meeting billionaires

The  whole story show how social media don change The game. Content creators like Arike fit connect with anybody even billionaire family just because their work dey heavy and e dey reach people.

“Dem wan work with me because dem like my content,”

talk, as e dey emphasize say The friendship just happen naturally, no be say e calculate am.

Wetin Industry People Dey Talk

Fellow content creators and people wey dey for The  industry don dey hail Arike say e talk true. Many people dey see am say na proof be dat say if your content hard, e go speak for you pass any social climbing.

The interview don scatter mouth for social media as people dey talk about how we dey quick judge influencers when we see dem with rich or popular people. Many people dey call say make we stop dey judge before we check facts.

attract opportunities wey you never even dream of and even if the opportunity come with mansion wey go make your mouth open sotey e no fit close.

The full interview dey available for Yanga FM;https://youtu.be/UjSzhW_sN2Y?si=jMOetUzI_CzrIgt5


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Continue reading

Current track

Title

Artist