Yanga FM 89.9

Compound Wahala

Compound Wahala

Compound Wahala by Presented by Rugged Pastor & BabyLawyer


Info and episodes

“Celebrity Wey Everyone Know Molest Me” – Denrele Talks

Written by on January 30, 2026

Denrele Edun Opens Up on Industry Demons

Denrele Edun no just waka enter Nigerian entertainment industry o baba enter with full feather and gele. Come dey shine like person wey no send anybody papa. But as e be so, the guy wey always dey jolly just yarn wetin fit make your body dey shake. For interview with yanga fm him no hold mouth, our presido don open book well well. Omo, the gist heavy die!

“Everybody Dey Look Me Like Say I Don Craze Finish”

When Denrele first land for the scene with him correct eccentric drip people for industry no dey smile at all. Instead, dem just dey look am one kain like say na alien land from space.

“People no fit understand why I bold reach like that,” him yarn, as e dey remember those early days. Those days  wey him fashion sense and him “I-no-send-anybody” vibes make am become the person wey everybody dey ask question about. While other people dey play am safe with their boring suit and regular behaviour, Denrele dey busy dey change the whole game for Nigerian media.

Denrele Edun interview

Denrele Edun interview

The Kpakpando Gist Wey Go Shock You

Na here the real bombshell drop o. Denrele open up say him  experience sexual harassment well for the industry . The kain thing wey fit make person vex tire.

“Dem dey do me somehow,” him  confess, as e dey yarn how bad people been dey think say because e different, e go weak.

“Omo, guy go just dey inside toilet dey mind him business, next thing the person go come dey try touch me anyhow,” him reveal.

From Reject to Respect

Even with all the harassment and discrimination wey him face, Denrele no just survive him also chop the industry scatter am. On top that, him change how Nigerian entertainment dey see people wey dey express themselves.

Today, young creatives dey hail am say na him be the original person wey make am okay to dey different, to shine well well, to reject all those boring boxes wey society dey put people inside.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist