Shoday Flip “TikTok Artist” Tag Into a Flex
Written by YangaEditor1 on February 13, 2026
Shoday: Na TikTok Davido Find Me, DM Me and We Do Nakupenda
By; Ezurumem Obinna
E no easy to just wake up one morning and find yourself inside studio with Davido. But for afro beats rising star Shoday, na exactly how the story go and him just yarn everything for Yanga FM interview. No filter. Full gist.
Back in 2020, Shoday carry him chest first. Him enter Davido DM like a sharp guy. Him even go Davido house personally! But oga no dey around. Door no open. Him pack himself go home. Case closed or so he think.
TikTok Enter the Matter
Shoday no give up sha. Him keep posting, keep grinding, keep doing him thing for TikTok like the algorithm na him personal PA. And e seems say the hustle pay, because last year, everything do a complete 360.
Davido see him for TikTok. OBO personally enter him DM, tell am straight say him like him songs and say make him drop something. Then text follow. Call follow. Video call sef enter the picture! Davido dey on him line like true fan and honestly, that energy dey warm heart.
3 Months Ghost Mode… Then Studio
Just as things dey get spicy, Davido disappear. Three full months nothing. No ping, no call, nothing. Shoday yarn say him almost conclude say na another industry “we go link” wey never happen. That kind cruise wey dey pain.
But then Davido change number, resurface, and come with one clear come link up for Zlatan studio. And just like that, Nakupenda born.
Zlatan No Even Suppose Dey the Song
Here na where e get funny. Shoday reveal say Zlatan no been supposed to feature for the track at all. But when you dey inside Zlatan own studio and the man dey vibe to the beat. Him enter the song and the rest na Afrobeats history wey we all dey enjoy today.
“TikTok Artist” Na Badge, Not Diss
Before the interview end, Shoday address the people wey dey throw “TikTok artist” like na insult.
Him point out say na through TikTok Davido discover am so if anything, the tag na flex. The app carry him name go the biggest table for Afrobeats.
watch video ; https://youtu.be/DknYc3BqvSQ?si=lgswbxQzi6iZcxam
