Yanga FM 89.9

yanga drive

Cruise Express

Cruise Express

Cruise Express


Info and episodes

The Bromance Wey Industry No Create

Written by on February 18, 2026

Wetin Dey Bond Shoday And Fola? Bromace wey sweet !

Shoday don come out for YangaFM recent interview, and the guy yarn everything raw, no filter.

The gist wey drop scatter timeline finish . Shoday confirm say him and Fola no be those two wey just link up because them don blow. These two been don dey roll together since before anybody sabi their name. Since before the streams, before the shows sell out, before the industry even notice say them exist.

Hustling Guys Jam For The Same Road

Shoday explain am simple  when you be upcoming artist wey dey find your feet, the industry go naturally dey bring you closer to people wey dey walk the same path.

Shoday on yanga

Shoday on yanga

Them dey parole, dey catch each other for shows, dey share the same underground spaces wey upcoming guys dey hustle from. No manager set am up. No PR person choreograph the whole thing. Just two guys wey dey grind, wey keep jamming each other until friendship just form by itself like akara wey don ready.

The Bromance Wey Dey Celebrate

The music industry full of people wey go smile your face today and collect your idea tomorrow. But the way Shoday describe their friendship for that YangaFM interview, e clear say this one different. Them genuinely vibe,even respect each other hustle. Them keep showing up in each other’s space until the universe just look down and say “oya, una don become padis, make una accept am.” And then the two of them blow. Almost same time. Like the friendship itself carry blessing.

 Story wey Make Heart Warm

For a world where celebrity friendship dey look like sponsored content, Shoday and Fola story hit different. Two upcoming guys wey find each other for the noise and confusion of the industry, hold each other down, and then watch each other shine.

No beef subplot. No competition wahala. Just pure, original brotherhood wey green rooms, late night shows, and shared hunger for success help build.

 

Watch video ;https://youtu.be/DknYc3BqvSQ?si=qAu5hqGIJM2ccMQZ


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Continue reading

Current track

Title

Artist