Yanga FM 89.9

yanga drive

Cruise Express

Cruise Express

Cruise Express


Info and episodes

₦200M and Him No See Kobo? Crayon Vex o

Written by on March 16, 2026

Crayon wake up Drag Don Jazzy ,Internet Catch fire !

Nobody wake up any regular Monday  morning expect say dem go see full celebrity meltdown but here we dey. Afrobeats artiste Crayon, wey Don Jazzy formerly sign under Mavin Records, don go social media drag him former oga finish. The crashout so loud, even people wey no sabi music industry dey feel am. And the timeline never recover and e no fit  recover anytime soon.

Wetin Crayon Actually Talk

Crayon come out fists up, accuse Don Jazzy say him thief him star and leave him without even one kobo from the alleged ₦200 million wey the label allegedly make from him work. According to Crayon, Mavin chop the money, carry the glory, share the credit and leave the artist with nothing but memories and one discontinued contract.

Crayon drop the heaviest bomb of all  say the stress wey the label put on him contribute to him mama death. That one land different. E no be ordinary music beef again. That one na grief talking. Raw, painful, unfiltered grief.

Why Him Crash Out Now?

People don dey ask  why now?  The answer dey simple. Crayon dey grieve him mama, and when pain full your chest, the mouth go open whether you like am or not. Some people for the internet even chook mouth say na the mourning wey push him to vex. Him  say the grief open old wounds wey him don try bury for years.

And just like that, the old receipts start comot.

Crayon Crashout tweets

Crayon Crashout tweets

Wande Coal Old Tweets Don Surface 

Sharp sharp, people begin dig archives and pull out old tweets from Wande Coal  another former Mavin artist wey allegedly call out Don Jazzy for the same wahala. Same pattern and closely knit story. Different artist, different year, same label, same energy.

Shey na Coincidence? The internet no think so.

Don Jazzy Never Talk — Streets Dey Wait

As of now, Don Jazzy never respond. Him dey quiet like person wey no see the notification. But the streets dey watch, the fans dey wait, and the comment sections don turn into full courtroom.

One thing clear sha Crayon no come to play. Him come for answers. And until somebody talk the truth, this crashout go dey trend for a long, long time.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist