Yanga FM 89.9

yanga drive

Cruise Express

Cruise Express

Cruise Express


Info and episodes

Chude Jideonwo Finally Sits In The Hot Seat

Written by on March 20, 2026

 

Chude Jideonwo: The Man Behind The Mic Finally Open Up

By : Ezurumem Obinna

Nigeria most famous listener just get interviewed  and him no hold back at all. Media guru, PR strategist, Red Media board member, and the man wey don make crying on camera look like superpower . Chude Jideonwo recently pull up for Yanga FM What’s Up Naija with Jaycee and BYBisasa. And things take very interesting turn.

The Interviewer Don Get Interviewed

There be something beautifully ironic about putting Nigeria most celebrated talk show host for hot seat. Chude build him brand dey ask other people hard questions.  When BYB flip the script, he room become very interesting fast.

And Chude? Him lean in. No dodging. No PR armor. Just the man himself  unfiltered and unbothered.

The Accountability Question Wey Nobody See Coming

Here na where things come get pepper. BYB come with question wey clearly don dey brew for long time, she  call out how some guests wey dey appear for Chude show allegedly dey use the platform as healing shield. Basically, people go show up, perform vulnerability, drop few tears, come sidestep accountability for their actions sharp sharp. Na real pattern. And BYB name am directly without blinking.

Chude with the whats up naija crew

Chude with the whats up naija crew

Chude Answer Na The Thing

Rather than dodge or defend himself, Chude give answer wey be equal parts wise and street smart. Him position? Simple but e go enter your head  we never know the complete color of a person.

In other words, whatever color somebody show you  na that color you go work with. You can only judge wetin dey stand in front of you. Nobody dey walk around with him full spectrum on display for everyone to see. people show you wetin them want you to see  and that one na their own business, not your own. Na the kind of answer wey go sound casual until you sit down with am for five minutes come realize say e just rearrange something inside your brain.

Why This Interview Hit Different

Chude Jideonwo don build entire career dey create safe space for other people truth. Thing be  watching him navigate questions about him own world  him show, him methods, him blind spots  reveal something even more interesting pass him guests. Him no just be media guy wey dey run talk show. Him be somebody wey genuinely dey wrestle with the same messy human questions wey him dey ask everybody else.

For media landscape wey full of noise, Chude Jideonwo remain one of the few people wey understand say the conversation never really finish.

Continue dey vibe with us ontop 89.9 yanga fm

Tagged as

Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Continue reading

Current track

Title

Artist