One Dance, One Breakup, Zero Apologies
Written by YangaEditor1 on April 9, 2026
Omah Lay : “Na The Boyfriend Vex Me, I No Sorry”
Afrobeats bad boy Omah Lay don finally address the concert dance wey scatter one relationship and e no dey plan to beg anybody.Him even yarn say the boyfriend no get levels.
The Night Wey Break Internet And One Couple Finish
Imagine am. London, February 2024. Omah Lay dey perform for front of 10,000 people wey dey craze for am. E carry one babe come stage make dem dance Bend You oh that him waist-requesting, body-rolling song wey no get chill. The dance go hot. The babe boyfriend just stand for crowd dey look. After that night, the couple break up. Video scatter everywhere for internet. Twitter/X turn to court. Everybody think say Omah go feel bad. E no feel bad at all at all.
E No Dey Apologize Na Vex E Vex
For new interview with FADER, the Port Harcourt singer skip the sorry part go straight to business. Turns out Omah no even think about the boyfriend except say the guy annoy am. “I was pissed. I was pissed at the guy for a minute,” e tell FADER. “This na girl wey get chance to dey on stage with one of her favorite artists. Na life-changing opportunity be that. If na me be am, I for dey record am dey happy for my girl.”
“Na Art Be That, Bro. One Minute Maximum.”
Omah Lay no understand wetin the noise about. For him eye, the whole stage dance na performance and no be love triangle or relationship wahala. The boyfriend wey dey sulk for corner? Na him personal problem that one.
“She’s coming back to you after the song is over! It’s art. It’s one minute max. Why you no just enjoy am?”
Then again Omah no stop there. E carry psychologist enter the matter, begin analyse the whole relationship say
“That just show say una no get anything concrete. I was disappointed in the guy. Like bro, wetin you dey do? Na just dance we dey do for front of 10,000 people.” This man don end person relationship AND their situationship for one interview. No mercy.
Who Actually Get Point For This Matter?
Na here e dey pepper. Omah Lay no dey entirely wrong as stage performance na theatre, everybody sabi that. Artists dey pull fans on stage all the time. As for grinding to Bend You specifically? That song no write for handshake and holy hug.
Even then , the boyfriend stand like statue while internet fry am like akara. Maybe Omah get point about confidence and trust. Maybe the relationship don already dey shaky before. Either way, one concert appearance do wetin months of quarrel no fit do wey be end everything finish.
