Qing Madi Yarn Say Nigerian Music Industry Dark
Written by YangaEditor1 on April 30, 2025
Qing Madi Talk Say Nigerian Music Industry Dark
Young Afrobeats star Qing Madi don open up about wetin dey happen for inside Nigerian music industry, and she no hold back.
Na for her Instagram story the 18-year-old singer wey her real name be Chimamanda Pearl Chukwuma, but dem sabi am as Qing Madi, drop one small but strong message:
“The industry is so dark.”
Her talk don follow wetin some other artistes don dey yarn since – say the music industry get some kind secret power and bad belle people wey no want make up-and-coming artistes grow.
Just recently, Reekado Banks talk say one “demonic” music executive dey use him power stop young talents from making it big. Before am, Kizz Daniel don talk say the industry na like “cartel” wey one kind “cabal” dey control.
Qing Madi no be stranger to controversy. Last year, she yarn say she lose plenty followers just because she preach about Jesus Christ for social media. But she still stand gidigba say she no regret am at all.
As Afrobeats dey take over the world, plenty people don begin ask:
Na spiritual wahala, industry politics, or both dey worry Nigerian music scene?
This matter still dey hot, and many eyes dey watch to see how e go end.